top of page

Who no want IVF baby?

  • Jan 28
  • 2 min read

Updated: Jan 29

Woman wey dey find pikin, na im know where shoe dey pinch am for leg

Some dey get husband wey go beat dem, odas go experience breakdown of their

marriage -all on top say dem never born pikin.


IVF (In-Vitro-Fertilisation) na opportunity wey plenti women around di world, wen no

fit get belle easily dey get from their doctor – and e dey work wella!

So wen we come dey hear say some pipo dey tok say IVF baby, no be ‘real’ baby or

di mama no be real woman, e dey make us vex seriously


Wetin be IVF?

IVF na medical procedure wen sabi doctor dem go take egg from woman, take

sperm from man, come join dem togeda for hospital . Di sperm go fertilise di egg .

After dat, dem go inject dis egg wey di sperm don fertilise inside woman womb

(uterus), where baby dey normally grow


Wetin you suppose know about IVF?

  • No be today IVF start

IVF don dey available for almost 50 years and sabi pipo wey dey monitor IVF,

tok say since dem born di first IVF baby in 1978, over 12 million babies don

drop, sake of IVF

  • IVF no be only woman problem. Sometimes, nothing do di woman, but na di

man fit get problem. For example, him fit no dey release enough sperm or

maybe di sperm no dey gree waka sharpally reach di egg

  • Some pipo dey tok say IVF baby no be di mama and papa bodi e comot.

Dat one na lie lie!

Na di sperm of di papa and di egg of di mama dem go join togeda, wey go

form di baby

  • Some pipo dey tok say baby wen dem born wit IVF go dey sick all di time

Dat one sef na lie lie!

Baby wey dem born wit IVF go dey healthy like baby wen den no born wit IVF


Which famous pipo don do IVF?

IVF na veri common procedure wey dey bring di joy of new pikin to many pipo

around di world. Some famous pipo for Naija and oda places don even tell us say

dem do IVF wen dem dey find pikin .



  • Adesua Etomi-Wellington

  • Ufuoma Mcdermott

  • Michelle Obama- former first lady for America (Barack Obama wife)

  • Mariah Carey

  • Celine Dion

  • Kim Kardashian

So, if you dey find pikin and you get option to do IVF, abeg no allow anybodi mumu

kill your hope

Go for it!

NOW!


©Wetindoyou April 2024

Comments


bottom of page