Wetin be Infertility?
- Jan 28
- 3 min read
Updated: Jan 31

Infertility na wen man and woman neva fit born pikin despite say dem dey get regular sex without protection.
Some pipo dey quick get belle, but for some oda pipo e dey take time.
Infertility fit come from either di man or woman. Before Doctor go fit say weda di problem na infertility, di husband and wife go don dey try conceive (to get belle) for at least over one year and belle no come.
Na two types of infertility dey:
Primary infertility- Dis one na wen pesin wey never born at all dey find am difficult to get belle.
Secondary infertility-Dis one dey affect pesin wey don get belle before, but as e dey try again, e dey find am difficult to conceive.
Wetin dey cause Infertility for man?
Health problems like diabetes or infection like gonorrhea or HIV fit affect di way di man bodi dey
produce sperm and di way di sperm dey function
Injury to di man reproductive organ, genetic disease and even premature ejaculation dey affect
di way sperm dey reach di woman bodi and e fit cause infertility.
Exposure to dangerous chemical, alcohol, cigarette and smoking marijuana fit cause infertility.
High blood pressure and depression still dey cause am.
Over exposure to hot temperature dey also affect di way di bodi dey produce sperm.
Wetin dey cause Infertility for woman?
Some disorder for woman ovulation like Polycystic Ovary Syndrome (PCOS) wey fit affect di way di woman ovary dey release eggs.
Too much heavy exercise, bad eating habits fit still cause am.
Growth(tumor) or fibroid for di wall of di woman womb fit cause infertility as e no go allow fertilized egg reach di womb or even stay for dere.
If di woman fallopian tube (tube wey dey carry egg reach di womb. Na inside this tube sperm dey fertilise di egg) dey blocked or damaged. Most times na sexually transmitted infections dey cause dis problem.
Endometriosis: This na wen endometrial tissue wen dey inside di womb normally come dey grow outside. If e happen, e go affect di way di ovary and fallopian tube dey work.
Early menopause: Dis na wen di ovary stop to dey work and menstruation end before di pesin reach age of 40.
Cancer and cancer treatment dey affect di ability of woman to get belle.
Sign of Infertility
Di main sign na say di pesin no go get belle. Oda sign no too dey show. Sometimes for woman wey get dis issue, dia period fit no dey come on time or di period fit just disappear. While for some men di way dia hair dey grow go change or dem no go fit dey perform well for sex
When Pesin Need to See Doctor
If di pesin don pass 35 years and e don dey try get belle for over six months
If di pesin period, no dey come on time or e don disappear.
If di period dey very painful
If di pesin don get miscarriage before
If dem don ever treat di pesin for cancer
Low sperm count
History of sexual problems
Family history of infertility
Some Risk factor wey fit Increase Infertility
Age: As pipo dey old, dia fertility level dey reduce. Di fertility level of both man and woman
above 40 years dey lower compared to wen dem dey younger.
Smoking of tobacco and marijuana: Dis one dey increase di risk of erectile dysfunction and low
sperm count for men.
Overuse of Alcohol: Alcohol fit decrease sperm count for men.
Wen pesin dey Overweight or underweight
How Husband and Wife fit Increase Dia Chance of Pregnancy?
Make husband and wife dey get sex regularly around di woman ovulation period. Na around dis time
woman dey most likely to get belle pass. Ovulation dey start halfway between woman period. So di
husband and wife need to have intercourse five days before di ovulation start and a day after to
increase dia chance of pregnancy.
For Man
Avoid drugs, tobacco and no dey drink alcohol too much
Dey avoid high temperatures.
Avoid exposure to any chemical wey fit affect sperm production.
Exercise regularly
For Woman
Avoid smoking.
Avoid alcohol and drugs.
Woman need to reduce di amount of caffeine wey she dey take.
Exercise regularly but avoid exercise wey too strong
Treatment
Di treatment wey Doctor go recommend go always depend on di kain problem di pesin get. Three main
types of treatment dey. Dem be.
Use of Medicines
Surgical Procedure(operation)
Assisted contraception like use of process wen dem dey call In Vitro Fertilization (IVF)
Follow your Doctor talk if you feel say you get any issue and e go give you correct advice !
Comments