top of page

Urinary Tract Infection (UTI) - for men

Wetin be UTI?

UTI dey happun wen bacteria for skin or rectum (rectum na di inside area wey lead to yansh hole where shit dey comot) enta inside bladder,  kidney or di area wey piss dey take comot

UTI dey more common wit women, man no dey too get am and usually na older man dey get dis kain infection

Signs wey dey show if na UTI

  • Pesin go feel pain or burning feeling wen him dey piss

  • Pesin go wan piss too many times

  • Pesin go get urinary urgency – dis one na to get sudden feeling to empty di bladder

  • Pesin fit get pain for lower abdomen

  • Blood fit show inside piss



Wetin fit cause UTI?

  • If pesin don get UTI before, e go dey easier to get am again

  • If pesin dey use urinary catheter (dis na bag wey doctor dey hook to di bladder of some pipo wey no fit piss normally, so urine go collect inside di bag)

  • If pesin no dey drink enough water

  • If pesin get kidney stone or prostate problem

  • If pesin get diabetes

  • If pesin get kidney surgery

  • If pesin no dey circumcised

  • Sex through di anus instead of vagina

*No be say evribodi wey get any of these problems must get UTI, but UTI go dey more likely for pesin wey experience any of dis tins


How you go treat am?

If pesin think say dem get UTI, e dey important to see doctor sharp sharp

Usually doctor go collect urine sample to confirm weda bacteria wey dey cause UTI dey inside, and dem fit do oda tests too

If na UTI, dem go usually treat am with antibiotic (no be any antibiotic o!, na di one wey go work for di particular bacteria wey show for test)

Even if you feel beta afta one to two days wen you start di antibiotic, you must finish all di antibiotic wey doctor give you, odawise all di infection no go clear o.

 

How pesin fit prevent UTI?

  • Pesin suppose piss anytime piss hook am, make you no dey try hold am

  • Drink plenti water – like anytime you get thirst and  after you chop finish . If you dey inside hot sun, you suppose even drink more water

  • Pesin must care for him genital area and anus well. E dey important to dey wash and dry dat area and keep am clean all di time

 

Comments


bottom of page