Urinary Tract Infection (UTI) -Women
- fouadkl
- Aug 28, 2023
- 4 min read
Updated: Mar 18, 2024
Wetin e be?
UTI na infection wey dey affect pesin urinary tract. Urinary tract na all di area wey piss dey pass through before e comot from pesin bodi. Di main area of di urinary tract na bladder, urethra and kidney If di infection dey pesin bladder area, dat one na cystisis. If e dey their urethra e go be urethritis, and if e dey their kidney dem go call am kidney infection.
How pesin go take know say dem get UTI?
Pesin go get pain as im dey piss – e go be like say fire dey inside as di piss dey comot.
For night, pesin go wan go toilet to piss all di time.
Piss go get cloudy (white) colour or e go dey dark and get strong smell.
Blood go begin show inside piss.
Pesin go dey feel some kain pain for belle or back area (under di ribs).
Bodi go hot and pesin go get high temperature, but at di same time, pesin go still dey shake like say cold dey catch am.
Sometimes bodi temperature fit go down veri low
Wetin dey cause UTI?
Wetin dey cause UTI pass na when bacteria from shit enter di place wey pesin piss dey follow comot from their bodi.
Di bacteria go enter di tube wey dey carry di piss comot. Dem dey call that tube urethra.
Urethra for woman bodi short pass di one wey dey man bodi and dis one mean say, di bacteria go dey quick reach di bladder or kidney to cause infection.
Some tings fit increase di chance of make infection enta pesin bladder:
Having sex
Wen woman get belle
Condition wey dey block di area where piss dey comot (for example like kidney stone)
Condition wey no dey allow person piss finish like prostate wey don swell (enlarged prostate) for man or wen pikin get constipation.
If pesin no dey drink enough water
If woman no dey wash dem vagina well or man no dey clean im penis and di area around am well well
If dem put tube wey dem dey call urinary catheter for pesin bladder to help dem piss, e fit cause infection
If bodi system no too strong to fight infection ( for example if dem get diabetes or oda long term disease).
How pesin fit prevent UTI?
Tings wey pesin suppose do
After pesin go toilet, e suppose dey clean from front to back
Dem go dey wash their vagina,penis and di area around am well well when dem dey baff and after even sex.
Dem go dey drink plenty water, so dem go dey piss well well and dem no go dey feel thirsty.
Immediately after pesin get sex finish, dem suppose go piss.
If pesin dey use nappy or pampers for baby, dem suppose change am immediately dem notice say di pikin don piss or shit inside.
Some people dey drink cranberry juice everyday, so dem no go get UTIs.
Wetin pesin no suppose do
Make woman avoid use soap wey get scent to wash di vagina area
Pesin no suppose dey hold piss anytime wey piss catch dem
If pesin dey piss, make dem dey take time to piss everything comot for bodi – no need to rush
Make dem no dey wear pant wey too tight and na cotton pant beta pass- dis one go allow breeze blow di area wel well.
No dey drink too much alcohol because e fit irritate pesin bladder.
No dey too take food or drink wey get plenty shuga. Di shuga fit allow make bacteria grow well well for inside pesin bodi.
How dem for treat UTI?
To check weda pesin get UTI, doctor go usually test dia piss If di piss get infection, doctor go usually tell dem to take antibiotic for some days. (If doctor tell pesin to take antibiotic , e dey very important make dem finish all di medicine, even if bodi don dey feel alright)
Sometimes, doctor fit tell pesin to wait for some days before dem begin dey use di antibiotic – dis one na to see weda di infection go comot for dem bodi by enself.
On top all dat, doctor also suppose:
Give advice about how pesin go fit dey take care of their bodi, and recommend drug wey dem go dey take for di pain.
After pesin get treatment and di UTI still dey come back den doctor go need to prescribe anoda antibiotic be dat
Oda tings wey pesin fit do wen dem get UTI
Dem fit take paracetamol -dis wan go deal wit any pain and high temperature
Pikin fit dey take liquid paracetamol.
Dem go need to rest and dey drink plenty water so dem go fit piss well well
Dem go need to avoid sex during dis time
UTI with belle
If woman get belle and their bodi dey show sign of UTI, she go need to see her doctor sharp sharp.
If she get UTI with belle, e fit make her blood pressure go up and even make her born di pikin wen time neva reach .
Commentaires