top of page

Syphilis

Updated: Nov 26, 2023

Syphilis (SI-FI-LIS)

Syphilis na infection wey pesin fit catch if you get sex with anoda pesin wey carri di disease. E dey important to get treatment as soon as possible because di disease fit cause serious complication if pesin no treat am quick


How syphilis dey spread?

As we tok before, syphilis dey usually spread wen you get sex with somebodi wey get di disease. E also dey possible to catch syphilis if pipo dey share needle when dem dey inject demself with drug. Dis kain tin fit happen to drug addict dem. Pregnant woman go fit pass di disease to dem baby But di disease no dey spread if pesin wear di same cloth or use di same plate chop or use di same toilet as pesin wey carri di disease





How you go know say you get Syphilis?

Most of di time e no dey easy to notice di sign and you fit pass am onto anoda pesin make you no know say you get am Some pipo no dey show sign at all say dem get syphilis but in odas, di sign fit disappear after some time. But dat one no mean say di infection don go – pesin still need to see doktor to get treatment.

Di first sign dey usually show around 2 or 3 week after pesin carri di infection:

  • Di main sign wey fit show for both man and woman dem na sore (small wound) on top man penis, woman vagina or around di anus area

  • Na usually one sore plenti pipo dey get, but sometimes e fit be more than one

  • Sometimes di neck area, groin (both side of di leg wey near penis or vagina) and armpit dey swell

Dis sign dey usually go away after 2-8 weeks but if pesin no get treatment, di infection fit enter anoda stage wey dem call Secondary Syphilis:

  • Red rash fit appear anywhere for bodi but usually for inside area (palm) of di hand or underneath di feet (sole)

  • White patches for inside mouth

  • Pesin go feel like dem get flu – tiredness, headache, joint pain and fever

  • Sometimes, pesin hair dey comot

All dis sign dey usually go after few weeks don pass. Sometimes, dem fit go come back many times before e no appear again.

Bet e no mean say as di sign no show again, di disease don clear be dat. If pesin no get treatment, syphilis fit dey inside bodi for many years, by which time e fit cause serious complicate.


Wetin fit happen if pesin no get treatment for syphilis?


If syphilis dey inside bodi for many years and e no dey treated, e fit spread to oda parts of di bodi like brain and nerves and cause stroke and blindness. Dat kind damage go dey permanent.


Treatment for Syphilis

If you get syphilis, na antibiotic doktor go use treat am E dey really important to finish di treatment for syphilis, odawise e go dey inside bodi and e fit cause serious problem


Na your doktor go tell you di antibiotic you go take


After you finish di antibiotic e go dey necessary to do test to check weda di syphilis don clear from bodi


E dey veri important make pesin no get sex when e get syphilis and for at least two weeks after you don finish treatment



Comments


Commenting has been turned off.
bottom of page