top of page

Stroke

Updated: Mar 7, 2024

Wetin be Stroke?

Stroke na veri serious condition wey fit kill pesin.

E dey happen wen blood no fit reach any part of di brain.

Stroke na big emergency wey need veri quick treatment. If pesin quick get treatment for di stroke, pesin fit survive and di problems wey e go get after no go too plenti.




Wetin be di Sign Pesin Wey Dey get Stroke go Show?

  • Face- di pesin face go drop for one side, e no go fit smile and di eye and mouth fit drop too

  • Arms-di pesin no go fit carri e two arms go up because di arm go dey weak

  • Speech-di pesin no go fit talk at all or if e fit manage talk, anoda pesin no go fit understand wetin im dey talk and sometimes im no go fit understand wetin anoda pesin dey talk

  • Time-if pesin dey show any of dis sign, time don reach to rush go dem hospital.


Wetin dey Cause Stroke?

Di brain need oxygen and oda different nutrients wey dey inside blood make e fit dey function well. If blood no reach di brain, di cells for inside di brain go dey die. E fit come make pesin get brain injury, disability or cause make pesin die.

Na two types of stroke na im dey:

  • Ischemic – Dis one na wen blood no fit reach di brain because of blood clot (blood clot na wen blood mix with oda tins come make am dey thick). Dis blood clot wey form dey block di passage wey di blood fit pass reach di brain

  • Hemorrhagic- Dis na wen blood vessel wey dey carry blood reach di brain come burst inside.

E get condition wey dem dey call ‘Transient Ischemic Attack’ (TIA).

Dis na wen blood no flow reach di brain for a short period of time.

E fit last for few minutes or e fit reach up to 24 hours. Wen e happen na warning say di pesin go fit soon get full stroke.

E dey really important to go see doctor for advice as soon as possible after di TIA even if di sign no show again.


E get some kain condition wey fit make person get stroke like:

High blood pressure (hypertension)

High cholesterol

High sugar level (diabetes)


How Dem dey Treat Stroke?

Dem dey usually treat stroke with medicine wey go prevent or dissolve di blood clots.

Di medicine go also reduce blood pressure and cholesterol level.

Sometimes di pesin fit need surgery.


Wetin dey Happen After Stroke?

Pipo wey survive stroke most times dey get problems wey di injury to dia brain dey cause. Some pipo go need treatment for a long time before dem fit recover well. Dem go need pipo wey go fit help dem after di stroke.


How to Care for Pesin wey don get Stroke

Almost all pipo wey get stroke go need pesin wey go fit help dem with dia normal activities. E get many ways wey pesin fit support e friend or family member wey don get stroke.

IMPORTANT

  • Help di pesin dey do exercise

  • Dey follow di pesin talk, give am hope say evritin go beta

  • Ginger di pesin make e fit reach e treatment goals

  • Try dey adjust for di pesin, according to di way e condition be. If e no fit dey understand pesin or even talk well, follow am talk small-small.

To care for pesin wey don get stroke no be small work.

E fit dey veri frustrating and pesin fit just weak for di whole mata.

E dey important to know say behavior of stroke patient fit just change one time, dem fit dey behave like say dem no dey think well again. Dis na because di stroke don affect dia brain.

Because di treatment for dia condition fit dey veri slow, dem carer must get patience, dey praise dem well wen dem show small progress.

Pesin wey dey care for stroke patient no suppose forget demself – dem must also take care of dia own physical and mental health


How to prevent Stroke?

Some tins wey all man fit do to prevent stroke include to dey:

  • Eat well

  • Exercise regularly

  • No dey too drink

  • Stop smoking

  • If pesin get anoda condition (like hypertension, diabetes) wey fit increase di risk of stroke, e go need manage dat condition well.For example, im must to take di medicine for lower di high blood pressure, cholesterol or diabetes regularly as doctor recommend.

  • If pesin don get stroke or TIA before, e dey extra important to do all dis tings, make anoda stroke no happen again.




Comments


bottom of page