top of page

Prostate cancer

Updated: Nov 26, 2023

Prostate cancer na di number one cancer wey dey affect black men Prostate na one kain organ wey dey near man penis and bladder. Im work na to help produce semen (di liquid wey spam dey inside)

Prostate cancer dey usually develop small small.

Pesin no go know say anyting dey until pesin go wan pee-pee all di time

  • or fit dey strain wen im dey pee

  • or dey get feeling say di bladder no empty ( na im be say di pee-pee still dey to release)

But pesin get dis signs no always mean say im get prostate cancer, but e dey good to check wit doctor if you notice dem.


Wetin dey cause prostate cancer?


Sabi pipo never sure of wetin dey cause prostate cancer. Di ting wey dem know na who fit get higher chance to get prostate cancer:

  • If you be man and you don reach 50 years, e go dey more likely say you go get prostate cancer.

  • Black/African men get higher chance to get prostate cancer

  • If pesin get close male relative (like brother or father)wey bin get prostate cancer before

  • Too much overweight fit also increase di chance of prostate cancer

How dem dey test for prostate cancer?

E get different test wey doctor dey use to check prostate cancer

The one wey common pass na:

  • Blood test- dis na special blood test wey dem call PSA (Prostate Specific Antigen) test. Sometimes di result from dis test fit get question mark because oda tings, no be only prostate, fit affect di result. If di level of di PSA for blood dey high, doctor go usually do oda test or scan to confam weda pesin get prostate cancer

  • Digital Rectal Examination (DRE): doctor go wear glove for hand come check inside di rectum (tru di anus) weda any lump or hard swelling dey

  • Biopsy



Treatment for prostate cancer


No be everybodi wey get prostate cancer go need treatment. Many pipo fit get am even up to 10 years make dem no need treatment

If di cancer dey early stage and no dey cause any yawa, doctor fit decide say best ting na to dey watch and wait to see how e go be. If e dey necessary to treat di cancer, den doctor fit do surgery (operation) to comot di prostate or use radiotherapy or hormone medicine treat am. All di different treatment dey come wit dem own problem like make penis no dey fit stand well well or difficult to control pee-pee. Das why doctor dey usually start treatment only if e dey necessary.

Comentarios


Los comentarios se han desactivado.
bottom of page