If man dey Quick Cum (Premature Ejaculation)
- fouadkl
- Mar 3, 2024
- 2 min read
Updated: Jan 31
Dis na one of di veri common sexual health problem wey dey affect plenti men wen dem dey get sex
We go talk about three main ones:
Premature ejaculation (Man dey quick cum – to release sperm during sex ).
Delayed ejaculation (E dey tay before man dey fit release sperm)
Retrograde ejaculation (Di sperm dey enta di bladder instead of to come out through di penis).
If any of dis problem dey worry you, Go meet your doctor and e go follow you talk about am.
Premature Ejaculation
Dis one dey happen wen di man dey quick cum pass wetin him and e partner dey expect wen dem get sex. If e dey happen once in a while, problem no too dey. But if e don dey happen evritime, di pesin fit need advice and treatment.
Wetin dey cause am?
Different kain tins fit cause am.
E fit be sickness for bodi or something wey dey worry pesin for mind.
For example:
Prostrate problem
Thyroid problem
If pesin dey abuse drug
Depression
Stress
Relationship problem
Pesin dey worry before e nack (maybe because e just enta di relationship or e don get dis issue before).
Some Tins Wey Person Fit do to reduce the problem
To wank (masturbate) small like one hour before pesin get sex.
Use condom wey thick.
Make di woman dey on top as una dey sex.
Counseling (advice) with therapist fit help pesin too
Delayed Ejaculation
Dis one na wen e dey tay before di man cum or di man no fit cum at all even if e dey try do am.
Wetin Fit Cause am
Relationship problem
Stress
Depression
Diabetes
Spinal cord injury
Bladder surgery
As pesin dey old
Some medicine sef fit dey cause am, like some anti-depressants or medicine wey dem dey use treat blood pressure.
Dis problem fit start overnight - Follow your Doctor talk if you dey see any of dis sign.
Retrograde Ejaculation
Dis one no too dey common.
E dey happen wen sperm dey follow wrong way, come go enta bladder instead of to come out through di penis.
Di main sign wey e dey show na say di pesin no go too produce sperm and if him come go piss, di piss go dey foam.
Dis condition fit make am no fit give woman belle.
Wetin fit Cause Retrograde Ejaculation?
Prostrate surgery
Diabetes
Some kain medicine wey dem dey use treat hypertension
Follow your doctor talk about treatment
Comments