top of page

Premature baby (baby wey dem born early)

Updated: Mar 7, 2024

Wetin be premature baby?

Some babies fit no reach di usual 9 months before dem comot from dem mama womb. Most of di time, dis kain baby go dey veri small and dem fit get health problem. Di earlier di baby quick comot from e mama womb, di more di health problem wey e go get dey plenti.



Why Some Babies Dey Come Out Early

E no dey always dey clear but some reasons na·        

  • If the mama get infection like toilet infection or diarrhea and vomiting.

  • If na more dan one baby dey belle.

  • If di mama cervix weak.

  • If di mama dey smoke.

  • If di mama no dey eat well.

  • If di mama dey overweight.

Sign wey premature baby dey show

  • Di baby go dey very small, but di head go wan big pass di rest of di body.

  • Hair go cover most of e bodi.

  • Di baby temperature go low well well.

  • E go hard for am to breathe.

  • E go hard to feed di baby.

Problems Wey Fit Come

No be every premature baby dey get health issue but some fit get:

  • Breathing problem: Di baby lungs neva develop well so e fit get problem breathing.

  • Heart problem

  • Di baby temperature go dey go up and down.

  • Digestion problem

  • Brain problem

  • Di baby immune system neva develop well so e fit dey quick sick.

 

Some premature baby fit get problem wey go affect di baby for e entire life like:

  • Cerebral Palsy: Dis one dey cause problem with movement and posture.

  • Learning problem.

  • Hearing problem

  • Eye problem: E fit develop eye condition wey no go allow am see well, come cause blindness join.

  • Teeth problem: E dey tay before di baby get teeth .

  • Behavior and mental health proble

  • Baby fit get several health issue and get risk of ‘sudden infants death syndrome’. Dis na wen baby die for no clear reason usually wen e dey sleep.

 

How Dem Go Fit Care for Premature Baby?

If woman get baby wey come early, di baby go need stay for special nursery unit for hospital. Some children go need to spend time for ‘Neonatal Intensive Care Unit’ (NICU). For here dem go care for di baby and monitor am day and night.

New mama need to ask her doctor and midwife how she go fit take care and feed di baby properly.

 


Comments


bottom of page