Plan your pregnancy
- fouadkl
- Jul 5, 2022
- 3 min read
Updated: Mar 14, 2024
If you dey plan get belle, you suppose take time to understand how to take care of your bodi and do tings wey go make am easier for di pregnancy to happen; wey go allow you to get easier pregnancy with no serious problem; and allow you to recover sharp sharp after you born.
1.Take folic acid
For evri woman wey plan get belle, e dey important to start to take folic acid early. Folic acid na medicine wey dey important for baby to grow normally inside belle and e dey prevent di baby from neural tube defect. Neural tube defect na when baby brain and spinal cord no develop properly. Di most common neural tube defect na spina bifida - condition where di spinal cord and bones for di spine no go develop well. Spina bifida na serious condition because e fit cause major problem like make pikin legs totally paralyse; pikin no go fit control im piss or poo-poo; or no go get feeling (like hot or cold) for im legs and lower bodi.
To prevent dis, e dey really important to start to take folic acid before pregnancy start and at least 12 weeks after you don get belle. Usually, woman wey dey plan pregnancy must take one 400 micrograms tablet of folic acid once evri day, but if you get diabetes, epilepsy or you or your partner get history of neural tube defect abi you don born pikin before wey get di condition, di advice na to take one 5 milligram (mg) tablet daily
E dey important to talk to your pharmacist or doctor about this
2.Watch wetin you dey eat
Woman wey dey plan pregnancy suppose dey chop plenty fruit and vegetable and avoid food wey go too pack plenti weight for bodi. Pesin wey dey overweight fit get problem to get belle and even afta e get belle, more problem like high blood pressure, diabetes or miscarriage (wen woman lose pregnancy wey neva reach 20 weeks) dey likely to happen.
After you don pregnant, e dey important to dey chop healthy food and to dey do some exercise (like walking, swimming or dancing) as e dey important not to gain too much weight.
E no true say pregnant woman gats to eat for two pipo. She just need to eat more good food wey contain wetin her baby go need to grow well well.
E dey important to drink enough water wen you pregnant so you no go constipate (wen e dey hard to poopoo)
3.No alcohol
No drink alcohol at all when you dey try get belle and after you don pregnant. Alcohol fit transfer to baby inside belle and e fit harm your baby for life.
4.Stop smoking
Smoking wen you get belle fit cause many different problem for baby inside belle; like make baby premature (when baby neva develop well before born time), low baby weight, breathing problem for di first six months after born time or make baby die suddenly wit no reason (cot death). Smoking also fit cause miscarriage
If oda pipo dey smoke around you wen you dey pregnant, di smoke from their cigarette fit damage your baby too. So e dey important make you waka comot if pipo start to smoke around you or ask make dem go smoke somewhere else
5.No take medicine anyhow wen you pregnant
Most of di medicine you go take wen you pregnant go transfer from you to your baby
If you dey plan get belle or you don already pregnant, e dey important to check wit your pharmacist or doctor. Make sure say you tell your doctor, pharmacist or your dentist say you get belle in case dem wan give you any medicine. If you dey plan get belle and you dey take any regular medicine for any health problem, e dey important to tell your doctor about dis.
Di best time for pregnant
Woman wey dey plan get belle need to dey meet with her partner regularly (like every 2-3 days) without protection (like condom) to allow pregnancy to happen at all.
Di best time to get pregnant na wen you meet your partner around di time of ovulation (wen woman ovary release egg; ovary na where egg wey go form baby dey kak for woman bodi). Ovulation dey normally happen around twelve to sixteen days before woman period start.
After di egg release, e dey last for only about 12-24 hours. Man spam gats to jam am during dis time if pregnancy go happen. Sperm fit dey active inside woman bodi for up to 5 days, so if woman meet her partner one to two days before ovulation, di sperm go don dey wait the egg.
Komentar