Malaria
- fouadkl
- Mar 3, 2024
- 3 min read
Wetin be bodi malaria?
Malaria na serious disease wey mosquito dey spread.
Only one mosquito bite fit infect pesin and if dem no quick treat malaria, e fit kill pesin.
Common Sign Wey Go Show if Pesin Get Malaria
Bodi go dey hot
Headache
Pesin go dey sweat well well
Cold go enta bodi like pesin wey get flu
Serious pain for muscle
All dis signs fit no show togeda and sometimes e dey hard to confirm weda na malaria
E get some category of pipo wey fit get more serious malaria.
For example:
Babies
Young Children
Pregnant women
Older people
So e dey necessary to give dis pipo extra protection against malaria
Wetin dey Cause Malaria?
Na Plasmodium parasite wey inside infected mosquito na im dey cause malaria. (Parasite na any living tin wey dey chop life on top anoda living tin (host), while im dey harm di host).
So, for malaria, pesin wey mosquito bite na di host.
Di malaria (plasmodium) parasite dey enta bodi wen mosquito wey get am bite pesin.
How Malaria dey take spread?
Wen mosquito bite pesin wey get malaria, e go suck di parasite from their blood, come hold am for im bodi. Wen di mosquito bite anoda pesin, e go carri give dem di malaria. Malaria no fit spread direct from pesin to pesin unless say infected mosquito bite pesin.
Wen mosquito wey carry malaria bite pesin, di parasite go enta di blood and den travel go di liver. For di liver, e go develop for some days or weeks before e go come enta di blood again. Na from dis time sign of malaria go start to show and pesin go need treatment sharp sharp.
Even though e no dey too happen, malaria fit spread from pesin wey get am to anoda pesin through blood transfusion or wen two people dey share di same injection needle.
Health problem wey fit Follow Malaria
Anaemia
Wen malaria enta bodi, e dey destroy red blood cells and e fit cause anaemia.
Anaemia dey wen di red blood cells no fit carri enough oxygen reach di bodi muscle and organ. Dis one go dey make pesin feel weak and eye go dey turn am. E fit come faint.
Cerebral malaria
E no dey quick happen, but sometimes malaria dey affect di brain. Dem dey call dis one ‘Cerebral Malaria’.
E dey make di brain dey swell up and e fit cause brain damage.
Pesin bodi go dey shake, and from there e fit enter coma (wen pesin dey unconscious)
Wen tins don complicate (especially if pesin no get treatment sharpally, malaria fit cause oda serious problem like;
Liver failure and Jaundice- wen pesin skin and di white part of di eye go yellow.
Shock- pesin blood pressure go just fall gbraa
Pulmonary Oedema- fluid go full di lungs
Breathing problem
Hypoglycemia-blood sugar go low
Kidney failure
Malaria for Pregnancy
If woman get malaria wen she get belle, big risk dey say she and her baby go get serious problem like:
Premature birth- she go born di baby early, before di belle reach di usual 9 months and di newborn baby go dey really small
Di baby no go grow for belle as im suppose grow
Sometimes e fit cause make di baby die as dem born am
Di mama sef fit die
Dis na why e dey really important for pregnant woman to avoid mosquito bite
How to Prevent Malaria?
Avoid Mosquito Bite
Many tins dey wey pesin fit do to avoid mosquito bite.
As mosquito no fit bite through cloth, try wear cloth wey light, wey go cover hand and leg.
Rub insect repellent for part of di bodi wey cloth no cover
Sleep under mosquito net wey dem don treat with insecticide or room wey get beta air conditioning- dis one no go allow mosquito bite pesin
2. Use Antimalarial Tablets for Prevention
Antimalarial tablet fit help to prevent malaria, make e no develop for inside bodi, but e still dey veri important to avoid mosquito bite.
Antimalarial tablet no dey stop malaria to enter bodi, but if e happun, di tablet go prevent make di infection grow for inside bodi and dat one no go allow pesin sick.
How for treat Malaria?
Pesin go recover well from malaria if e get treatment sharp sharp.
Follow your doctor or pharmacist talk about which malaria treatment go dey good for you. Dem dey usually treat pesin with tablet or capsule but if di sickness serious well well, pesin fit get treatment with injection or drip.
E dey veri important to follow advice wey your doctor or pharmacist get for you about which antimalarial tablet go good for you.
Comments