Insomnia (lack of sleep)
- fouadkl
- Mar 2, 2024
- 2 min read
Wetin be Insomnia
If pesin dey regularly struggle to find sleep, na im be say dem get insomnia be dat.
Most of di time dis problem dey get better if pesin change dem sleeping habit
How to check weda you get insomnia
If e dey hard you to find sleep for night
If you dey wake many times for night after you don sleep
You just lie down, no fit close eye for night
You dey wake up too early, no fit go back to sleep
If you still dey tire after you wake from sleep
Even wen you tire, you no fit sleep during di day and you no fit concentrate
You dey tire during di day and any small ting dey make you vex
If you get any of dis problem regularly, na im be say you get insomnia be dat
How much sleep all man need?
Different pipo go need different amount of time to sleep
Most baby and small pikin dem go need between 12-17 hours of sleep in one day
Most children go need between 9-12 hours
Most adult go need between 7-9 hours (but remember, some pipo fit need less dan dis and dem go dey kampe)
Wetin fit cause Insomnia?
If pesin get stress or depression
Wen noise no gree pesin sleep
If room dey too hot or too cold
Bed dey uncomfortable
Alcohol or cigarette fit affect sleep
If pesin dey abuse drug
If pesin take long flight for aeroplane
If pesin dey do shift work – like to start work for night finish for morning
Wetin you fit do if you get insomnia
Most of di time, insomnia go improve if pesin change dia sleeping habit, so e dey important to do di following :
Try go bed for night and wake for morning at di same time evri day
Try relax for at least one hour before bedtime – you fit shower to help you relax
Make sure you no get bright light for inside room.
Di room suppose dark and quiet to help you relax. You fit use curtain or eye mask block any bright light
Make you dey try do exercise during di day, so bodi go tire and ready for sleep
Make sure say your mattress and pillow dey comfortable
Make you dey avoid:
To smoke, drink alcohol, tea or coffee close to bedtime
Chop heavy food for late night, close to bedtime
To watch television or use your phone wen you dey inside bed or dey prepare to sleep. Di bright light wey dey shine from inside dis devices no o gree you sleep
To sleep during di day
After you don try all dis method and you still no dey get correct sleep, you suppose talk to your doctor
Commentaires