Hypertension
- fouadkl
- May 24, 2022
- 2 min read
Updated: Nov 26, 2023
Hypertension na anoda name for high blood pressure
High blood pressure dey happun wen di powa wey blood dey take pump around di bodi too high.
E dey veri common make pesin no know say im get hypertension. Dis wan dey veri dangerous as hypertension go give your heart, blood vessel, brain and other organs extra work and fit cause serious gbege like heart attack, stroke and kidney disease.
Hypertension dey veri common wit black pipo and WHO tok say in di whole world, na Africa get di highest number of pipo wit hypertension. May of dis pipo no even know say dem get di problem.
No be only old pipo dey get hypertension, e fit happun at any age
Evribodi blood pressure no go be exactly di same, but normal blood pressure no suppose low or high pass certain range wey your doctor ,pharmacist or nurse go fit tell you.
Check your blood pressure
Di only way to confam weda you get hypertension na to check your blood pressure.
You fit check am for hospital or ask your pharmacist weda dem fit chem am for you
Evribodi wey don pass 40 years suppose dey check dem blood pressure at least evri 5 years. As pesin dey age, blood pressure dey rise gradually, so advice na to dey check more regularly dan evri 5 years. If doctor tell you say your blood pressure high, im go tell you weda you go need to check am more frequently.
If you like, you fit buy blood pressure machine to dey use for house- e dey easy to buy dis from any good pharmacy.

Wetin fit cause hypertension
E no always clear why pesin dey get hypertension but e get some tings wey fit increase di chance of getting di disease:
Pesin dey overweight (very fat)
Pesin dey eat too much salt but not enough fruit and vegetable
If pesin no dey do enough exercise
If pesin dey drink too much alcohol of coffee
Pesin dey smoke
Pesin no dey get good sleep
If pesin don pass 65 years
If you be black pesin
If you get relative wey get hypertension
If pesin dey take medicine wey fit increase blood pressure (E DEY IMPORTANT TO ALWAYS ASK YOUR PHARMACIST HOW ANY NEW MEDICINE WEY YOUR DOCTOR PRESCRIBE OR WEY YOU BUY FOR PHARMACY FIT AFFECT YOU)
If we fit avoid many of dis tings and better our lifestyle, den di chance of hypertension fit reduce.
Treatment for Hypertension
On top di lifestyle improvement, a lot of di time e go necessary for your doctor to give you medicine for hypertension. Depending on how serious di hypertension be and how di medicine dey work for bodi, pesin fit need one, two, three or sometimes even four medicine to treat dem hypertension. A lot of di time, e go necessary to take di medicine for life but make dat one no panic anybodi becos di work wey di medicine dey do for bodi, no be small and e fit be say na im go save your life.
Comments