top of page

HIV and AIDS

Updated: Nov 26, 2023

Wetin be HIV?

HIV (Human Immuno-deficiency Virus) na serious virus wey no dey allow bodi fight simple infection as normal.


Wetin be AIDS?

AIDS (Acquired Immune Deficiency Syndrome) na di name of di sickness wey di HIV virus dey cause wen e don cause damage for bodi

Usually di HIV virus go transfer wen pesin wey get am get unprotected sex (sex wit no condom) with anoda pesin. Di virus also fit transfer wen pipo wey dey abuse drug like cocaine dey share needle or wen woman transfer am to her baby wen she born or wen she dey give breast

Many pipo no dey sabi say dem get the virus because e fit no show any sign for bodi for many years.

HIV never get cure, but plenty medicine dey available to treat am and pipo wey get HIV fit live long

E dey important to also know say di virus no fit transfer from saliva, or urine or sweat.


Sign wey you fit notice if you get HIV?

HIV virus fit dey pesin bodi for many years make im no know. This na because di sign wey dey show for bodi be like wen pesin get oda sickness like cold and flu

After around 2-6 weeks after di virus enter bodi, plenti pipo go get high temperature, sore throat and bodi rash, joint pain, muscle pain and tiredness. All dis fit last for like 1-2 weeks. After dat pesin fit no experience any problem again for many years (even up to 10 years)

If pesin no begin get treatment, during dis time, di virus go start to weak bodi inside until bodi no go fit dey fight even small infection like cold or cough. Wen di damage don too much, pesin go begin see sign like:


  • Losing weight

  • Plenti watery poo-poo

  • Plenti sweat for night

  • Skin problem

  • Infection wey no dey finish


How you go confam weda you get HIV?

Di only way pesin fit know weda him get HIV na to do test. Di test go check your blood or saliva to see weda you get HIV.


If you suspect say you get HIV, e dey important to try do test as soon as possible so you go begin get treatment on time before di virus dey too difficult to control.




How you go prevent HIV/AIDS to dey spread?


  • Make you dey use condom anytime you wan get sex

  • If you be drug addict, make you no dey share di needle wey you dey use chook yourself with oda pipo


Treatment for HIV/AIDS


Even though HIV/AIDS no get cure, plenty medicine dey wey fit fight di virus and allow pesin live normal life. But dis na only if di disease neva too worse and you dey take di medicine as you suppose take am. After you don do test wey confam say you get di virus, di medicine wey dem dey use treat am na antiretroviral medicine. Antiretroviral medicine no go allow di virus multiply inside bodi, so bodi go fit repair im self.

Usually na combo of medicine you go get, maybe like three or four. Becos di virus dey quick change inside bodi, each one of di medicine for di combo go fit attack di virus any which wey e go change. Sometimes, dem fit don package the combo togeda inside one tablet. Na different combo dey work for different pipo, so di one wey you get na your own special combo wey your doctor believe go work for you after e don check your test result.

As you dey take di medicine, your doctor go dey check your blood weda di virus dey reduce. For many pipo wey dey take HIV medicine evri day, usually after 6 month, test no go show any virus inside di blood.

Make you always dey careful with HIV medicine because most of dem go clash with oda medicine, so you gats to always check with your doctor or pharmacist before you take oda medicine.











Comments


Commenting has been turned off.
bottom of page