top of page

High Cholesterol (KO-LES-TE-ROL)

Updated: Nov 26, 2023



Wetin be High Cholesterol?

  • High cholesterol na wen too much of fat wey dem dey call cholesterol dey inside pesin blood.

  • Mani times, di tin wey dey cause am na wen pesin dey eat food wey get plenti fat and di pesin no dey do enough exercise. Smoking and drinking still dey cause am too.

  • E dey run for families too. Dat means, if papa or mama get am, di pikin fit get am too.

  • Pesin fit lower im cholesterol level wen im dey eat healthy and do correct exercise.

  • Some pipo need to start medicine for am.

  • Too much cholesterol fit block pesin blood vessel and e fit lead to heart problem or stroke

How Pesin fit Check for High Cholesterol?

High cholesterol no dey give sign.

Na only through blood test pesin fit know weda im get am.

Doctor fit suggest make pesin do test if e dey feel say im cholesterol level high.

Pipo wey don pass 40 years and dem fat or get other kain disease like diabetes or high blood pressure or if one of dia family member don get very high cholesterol level before need to do test.


How you fit reduce di Cholesterol Level?

1. Pesin need to reduce di way e dey eat food wey get fat. E need to reduce food like:

  • Meat pie, Sausage

  • Butter

  • Cake and biscuit

  • Food wey contain palm oil.

E good to dey chop more food like:

  • Oily fish like mackerel and salmon

  • Brown rice, wholegrain bread

  • Different kain nuts and seeds

  • Fruit and vegetable

2. Pesin also need to do more exerciseAt least 2 hours of exercise evri week dey very necessary. Pesin fit try different kain exercise like walking, swimming and cycling till im see di one wey e go enjoy.

3. Stop Smoking

Smoking dey raise cholesterol level well-well and e fit cause serious problem like heart attack, stroke and cancer.

4. Pesin also need to reduce di amount of alcohol wey e dey take.

If Pesin cholesterol level never go down after e change di kain food wey e dey eat and e don already start exercise, doctor go recommend medicine wey e go take to lower di cholesterol level.




Comments


bottom of page