Heart Attack
- fouadkl
- Mar 2, 2024
- 2 min read
Wetin be Heart Attack
Heart attack dey happen wen blood wey suppose flow reach di heart suddenly stop to flow because di blood vessel don block.
Plenti times, di blockage na because of sometin dem call blood clot (blood wey thick, come gum togeda, no gree flow again)
Heart attack na serious emergency and wen we suspect say anybodi get heart attack, na to carry dem go hospital sharpally to avoid serious gbege
Sign wey pesin fit show if dem get Heart Attack
Chest pain: chest go feel tight and heavy, like say sometin dey squeeze di whole chest
Pain for oda part of di bodi: e go feel like di pain dey spread from di chest go di left arm (or sometimes both arms), di jaw, neck, back and belle
Pesin go feel dizzy
Pesin go dey sweat
Dia breathing no go normal
E go feel like dem wan vomit (dem fit do di vomit sef)
Pesin fit get some kain feeling of fear and panic
Pesin fit dey cough
Most of di time di kain chest pain wen pesin wey get heart attack dey experience no get part two, but for some pipo di pain no too serious like dat.
But e important to know say even though chest pain na di most common sign for pesin wey get heart attack, some pipo dey experience oda tins like breathing problem, pain for jaw or back or dem fit wan vomit, without chest pain.
Wetin dey cause heart attack
Coronary Heart Disease (CHD) na di main cause of Heart Attack
CHD na condition wen di major blood vessel wey dey carry blood reach di heart don dey collect fat wey go dey narrow di blood vessel (think am like pipe wey get fat wey dey build up for di inside wall). Na plaque dem dey call dis collection of fat
Before pesin get heart attack, one of di plaque fit break, block di vessel, fit no come allow blood flow reach di heart again
How to prevent Heart Attack
E get some ways to reduce di chance of Heart Attack :
Pipo wey dey smoke suppose stop smoking
Try lose weight if you get too much weight
Try dey do regular exercise
Eat correct, healthy food evri day (with low fat plus plenti fruit and vegetable)
No drink too much alcohol
Remember, if you suspect say anybodi dey get Heart Attack, rush dem go see doctor as soon as possible- you fit save their life
留言