Gonorrhoea (GO-NO-RIA)
- fouadkl
- May 24, 2022
- 2 min read
Updated: Nov 26, 2023
Gonorrhoea na sexually transmitted disease wey fit affect both man and woman. E dey very common especially among young pipo wey dey sexually active. Gonorrhoea fit cause infection for man penis, woman vagina, anus and sometimes even inside mouth and eye sef. Na one kain bacteria wey dem dey call Neisseria Gonorrhoea dey cause di disease.

How gonorrhoea dey spread?
You fit catch gonorrhoea if you get unprotected sex wit pesin wey get the disease. Di bacteria wey dey cause gonorrhoea dey inside di discharge wey dey comot from penis or vagina of pesin wey get di disease.
Gonorrhoea fit also pass from pregnant woman wey get am to her baby. If you pregnant, and you think say you get di disease, e dey veri important make you go see doctor for check up and treatment before you born your baby as di new baby fit blind if you no get treatment.
E dey important to know say gonorrhoea no fit spread wen you kiss or hug pesin or you dey use di same plate, cup or cutlery wit dem.
How you go know say you get gonorrhoea?
Di common sign for men wey get gonorrhoea na:
Pain or burning feeling wen you dey piss
White, yellow or green discharge go dey comot from tip of penis
Sometimes, di testicles (balls) dey swell and e dey painful, although dis no dey veri common
Many woman no dey show sign wen dem get gonorrhoea but di sign wey woman fit see na:
Pain or burning feeling during piss
Yellow or green discharge go dey comot from vagina
Pain for lower abdomen area (but dis sign no dey too common)
Vagina go dey bleed between one period and anoda or after sex (but dis sign no dey too common)
If you get any of di signs, e dey important make you go see doctor sharp sharp because gonorrhoea fit cause serious complicate if pesin no treat am quickly.
Treatment for gonorrhoea
If you do test wey show say you get gonorrhoea or your sex partner get gonorrhoea, den you go usually need to take antibiotics.
Make you no take any type of antibiotics- na di one wey your doktor say make you take only you must take. E dey important to finish di antibiotics wey doktor recommend for you to allow make e work wella. After you finish di antibiotics, e dey advisable to do anoda test to check weda di gonorrhoea don clear for your bodi. E dey important make you and your partner avoid sex from wen you know say you get di disease until wen e clear for your bodi.
Comments