top of page

For Woman Dem: Shine Like Superstar!

Updated: Mar 7, 2024

For all our woman dem! Mama, aunty, sister, pikin.

Dis matter no be beans at all o.

E get as e be!



Everyday different wahala and kata-kata of life fit dey stress you and e fit make you just dey para and no make you happy at all.

E fit be work, family, pikin, or oda tins.

With all dis problem e fit come dey hard to remember to care for your health.

But make I yarn you, as woman, e dey veri important make you no forget to put your health first. We wan share some tins wey you suppose do to help you improve your health.


First of all, how you take dey sleep?

Sleep na ogbonge medicine for your mind and bodi.

No dey form super woman o!

Make you dey try get at least 6-7 hours of sleep every night.

E go help your bodi recharge even after you don get kata-kata stress during di day.

No dey go press your phone or watch television wen time for sleep don reach.

Try make you no dey sleep for bed wey rough- arrange your bed well and e go make di sleep quick catch you and you go see say di sleep go come sweet you for bodi join.


Anoda tin wey you need to manage na Stress.

Too much stress no good for bodi at all. E dey put pesin for thinking, and like film trick e fit just make di blood pressure shoot up like naira to dollar rate!

But, no worry, solution dey.

Make you dey try do exercise and make sure say you find somebodi to dey yarn wit regularly- no dey too hold anytin wey dey worry you for chest, you gats talk am .

You go see how e go comot small pressure from your bodi and make you feel like say dem pour pure water for your bodi under hot sun.


Abeg, no dey siddon for one place from morning till night.

No be so at all! Dey waka!

Exercise dey veri important.

Try target at least 30 minutes of small-small exercise everyday.

And di exercise no need to dey too hard. You fit start from small waka, then e fit increase to jogging.

If you wan ginger you fit even try yoga.

All dis exercise go help reduce di risk of some kain disease like heart problem, diabetes and e fit even prevent some kain cancer.

E go improve your mood too, you go dey shine like superstar!


Food dey veri important too!

You no fit joke with correct food.

Dey eat balanced diet wey get plenti fruit and vegetable.

And reduce di way you dey take drinks wey get plenti sugar or alcohol.

No dey form shuga daddy or shuga mummy with all dis drinks, e no good for your health.


If you get di opportunity, make sure say you do regular check-up with your doctor, make dem check your cholesterol, blood pressure, blood sugar, breast check and oda tins. E fit help you catch any potential health problem before e become serious.

Prevention dey always better pass cure!


Woman wey just born pikin need special care and attention.

To take care of newborn baby no easy at all and only di mama no fit do all di work.

She sef need to get rest.

As pikin dey sleep, make mama try use dat time rest too.

If possible, make she get pesin wey go help am care for di pikin make di work no too fall yakata for her head. Dem fit help with small-small tins like to change the pikin nappy, baff and even feed am sef.

As dem dey do dis one di mama go fit get small time to rest.


All dis small-small tins wey we dey talk for here fit make veri big difference for woman life. If woman rest well, do exercise from time to time, add balance diet join, den come top am off with regular checkup, she go fit stay healthy, come dey shine like superstar!


Comments


bottom of page