Female genital mutilation (FGM)
- fouadkl
- Aug 28, 2023
- 4 min read
Updated: Mar 18, 2024

Wetin be FGM?
Anoda name for FGM na female circumcision or cutting.
Dis na wen dem cut part of di genital of a woman or girl comot without say she get any medical problem.
Usually na young girls dey suffer FGM – e dey usually before dem reach di age of puberty (dis na age wen girl bodi dey start to change to woman bodi) . Many times FGM dey happun between di time wey dem born girl pikin to di time wey she reach 15 years
FGM dey cause serious pain and e dey affect di health of di pikin up to wen she grow, become woman. She fit get problem when she wan get sex, when she wan born her own pikin, and e fit affect her mental health too.
Many times, na people wey be traditional circumcisers wey no get any medical training dey do FGM. In some oda countries, di people wey dey do this FGM go don go medical school go get medical training.
Dem no dey use anaesthetics wey no go dey make di girl pikin feel di pain and dem no dey use antiseptics. If dem wan do FGM, na knives, scissors, glass and razor blades dem dey use do am.
If dem wan do FGM for pikin, dem no go ask am whether she wan do abi she no do and if she no gree, dem go use force take hol am down.
Wetin FGM dey do for woman bodi?
FGM no dey do anything good for woman bodi Instead e dey cause plenti problem like:
Di girl or woman go always dey get pain.
She fit dey bleed more than normal or her genital area fit get some swelling.
E go hard am to get sex because of the pain
She go dey get plenti infection and dis one fit no allow her get belle
E go hard am to hold her piss. Anytime piss catch am, she go dey need to piss sharp sharp or else she go piss for bodi
Wen she dey remember how she suffer for di cutting plus all di wahala wen she dey experience for her bodi on top di FGM , she fit dey veri sad and depressed. Dis wan fit cause make she wan harm herself
Di FGM fit cause problem when woman dey born pikin . If she dey struggle too much during labour, dis one dey very harmful for both she and di baby. One or both of dem fit die
How FGM fit affect sex.
E go dey difficult for girl wey don experience FGM to get sex because e fit dey veri painful for her. Because of dis problem, bodi fit no dey do am to want sex and even wen she get di sex, e no go sweet am for bodi
If woman wey get FGM feel say she dey get problem with sex, she go need discuss wit her doctor so him go send am go see specialist (senior doctor)
Sometimes, e go dey necessary to do operation to solve di problem
How FGM fit affect pregnancy.
Woman wey get FGM dey usually get some problem wen e reach time to get belle, born pikin. Many no go fit carri belle, and even wen she fit, problem fit dey wen time reach to born.
E dey important make woman wey get FGM tell her nurse or doctor tey tey before she reach to born. Dis na so dem go fit prepare well wit correct plan for she and her baby wen e reach to born
How FGM fit affect mental health.
To go through FGM na really bad thing for girl pikin or woman. Di experience dey affect woman throughout her life in many ways like:
She fit dey depressed
She fit dey get panic
She fit dey remember di time wen dem cut her.
She fit dey get bad dream or other problems when she dey sleep.
If dem do FGM for woman when she be small baby (before she don reach 1 year) she fit no remember say dem do FGM for am. She fit need to see her doctor if she get any emotional or mental issues and she feel say na FGM cause am.
How dem dey treat FGM.
If dem wan treat FGM, na some kain surgery dem go do Dis surgery no dey replace any skin wey dem don remove and e no dey undo any damage wey FGM fit don cause for the woman bodi.
But e dey help with some problems wey di woman dey face because of FGM.
Dem fit do di surgery if:
1. Woman no fit get sex or she dey get problem when she wan piss.
2. Woman don get belle wey be say to born di pikin go be big problem for am.
Normally, woman suppose do di surgery before she don get belle, but if she don already get belle, she still fit do am if e dey necessary but she go need to do am before di last 2 months of pregnancy.
Comments