top of page

Erectile Dysfunction (ED)

Updated: Mar 14, 2024

Erectile Dysfunction na wetin plenti pipo dey call impotence.

Na wen man no fit get good erection ( wen penis no fit stand and even wen e stand, e dey quick go down). This one no go allow man do sex wit im woman properly.

ED dey frustrating to all man because e dey hard for man to talk about di problem wit odas.

Even though e dey hard dem to talk about am, this na veri veri common problem wit man especially from like age 40 years. But e get many younger men wey dey get di problem too.



Wetin dey cause ED?


E get different reason why man dey get ED

  • One of di common reason na wen blood no dey flow enta di penis well because pesin get oda disease like hypertension, high cholesterol or diabetes

  • Pesin get injury or do operation

  • Anxiety: wen pesin too carri sometin for mind, come dey worry or dey fear

  • Depression: dis na wen pesin dey get strong feeling of sadness wey no dey gree comot easily

E get some men wey dey experience ED only sometime. For example, some men fit get erection wen dem play wit demself or wen dem wake up for morning but dem no go fit get erection wen dem dey wit dem partner. This kain ED get psychological reason ( na im be say e get to do wit stress).

If person no fit get erection at all, na anoda tin (like injury or disease) dey cause am

Sometimes na medicine wey pesin dey take for oda problem dey cause ED


If you tink say you get ED, make you try see doctor, make you no embarrass because na veri common problem. Plenti treatment dey to help you and doctor go fit ask you question and examine you to know di kain treatment wey go help you

Comments


Commenting has been turned off.
bottom of page