top of page

Domestic violence and abuse

Updated: Jan 31



Wetin e be?

Domestic Violence, or domestic abuse na any physical, emotional or sexual abuse between two people wey dey relationship or people wey dem be family members.

Pesin fit get abuse in many ways but all di time, di abuser dey always try get power and control over di person wey im dey abuse. Sometimes, pesin fit suspect say anoda pesin dey go through abuse if dem notice say di pesin dey fear their partner or dem change their behaviour sake of say dem dey fear wetin their partner fit do to dem.


Emotional abuse.

Person fit get emotional abuse if some or all of these things dey happen to am.

If dem partner or pesin wey dem dey live with for di same house dey:

  • Insult dem or always try make dem feel like say dem no sabi anytin

  • Try put blame for di abuse or argument on top their head.

  • Deny say di abuse dey even happen at all or e go dey do like say na small thing.

  • Try keep dem from their family and friends

  • Tell dem make dem no go school again abi make dem no dey go work again.

  • Always ask for their attention even wen e no really need to.

  • Accuse dem say dem dey flirt with anoda person or dem dey follow anoda person.

  • Try control wetin dem fit wear, who dem fit see, where dem fit go and wetin dem go dey think.

  • Control di money wey dey their hand and di abuser fit no go dey give dem enough money to buy wetin dem need.

  • Control their social media account abi make e dey share dia picture and video without their consent. E fit even dey track all di places wey dem dey go


Physical abuse.

Abuse fit dey happun if one pesin dey woze anoda pesin physically, to wunjure am or make am feel bad Na physical abuse if pesin partner or somebodi wey dem two dey live togeda dey do am one of di below:

  • Dey slap, hit or give am blow

  • Dey push am

  • Bite or kick di pesin

  • Use fire or something hot take burn di pesin body.

  • Hold pesin for neck or hold am down

  • Throw sometin at di pesin


Sexual abuse.

If pesin wan know weda dem or anoda pesin dey go through sexual abuse, dem go need check weda di pesin partner or anoda pesin wey dem dey live togeda dey do one of dis tings:

  • Dey touch dem in some kain way wey dem no too want.

  • Dey always ask for some kain sexual things wey pesin no wan give.

  • Dey wunjure di pesin anytime wey dem dey get sex.

  • Dey pressure di pesin say make dem get unsafe sex ( dis one mean say dem dey pressure di pesin make dem no use condom wen dem get sex)

If pesin force anoda pesin to get sex, na rape be dat. Even if dat pesin na dia partner, still na rape.


How pesin fit help their friend wey dey get abuse

If pesin dey think say their friend dey get abuse, dem fit let di friend know say dem don dey notice say something dey happun. Many time, pipo fit no wan tok about di problem, but if dem decide to tok, e good make to find quiet time to allow dem tok in private

Anybodi wey anoda pesin dey follow talk about domestic violence suppose:

  • Listen and try no blame di pesin.

  • Make di pesin know say, to tok about wetin dem dey go through show how strong dem be

  • Allow dem time to talk, no rush dem

  • Dey remind dem say e no matter wetin di abuser follow dem tok, nobody deserve wetin dem dey experience

  • If dem no wan comot for di relationship wey dem dey, no try force dem . Na to dey encourage dem to make di right decision

  • Ask dem if dem get any injury from physical abuse, if dem get, try follow dem go see doctor.

  • If di person decide to report wetin dey happun to police, try follow dem report di assault.

Domestic Abuse for Pregnancy.

As we don tok before, domestic violence or abuse fit be physical, sexual, psychological or emotional. Most of di time e go be combo of all of these

Pregnancy fit cause di abuse. And if person don dey get abuse before, once pregnancy start or after di woman don born, di abuse fit dey worse.

If domestic abuse dey happen during pregnancy, na danger for di woman and di pikin wey she dey carry be dat. E fit cause miscarriage, infection, premature birth, injury or di pikin fit die sef.

E fit also cause some problem for di woman wey fit affect di baby - like some emotional and mental health problem like stress wey fit affect di development of di pikin.

If person get belle and e dey get abuse, di person go need get help sharp sharp!

Make di person follow friend wey dem trust, doctor or midwife talk about di issue.

Comments


Commenting has been turned off.
bottom of page