Diarrhoea (DA-YA-RIA)
- fouadkl
- Jul 5, 2022
- 2 min read
Updated: Nov 26, 2023
Wetin be diarrhoea?
Diarrhoea na wen pesin dey get liquid poo-poo wey wan be like water up to 3 or more times in one day. Diarrhoea dey veri common and e fit affect adult, children or baby. All man get bodi water wey dey help our bodi function well. Wen pesin get diarrhoea, too much water dey comot inside poo-poo. Dis go make pesin weak and bodi no go fit function well.
Wetin dey usually cause diarrhoea?
Diarrhoea dey usually happen wen pesin get infection like virus or bacteria for stomach. Di bacteria or virus fit enter bodi wen pesin drink water wey no clean or chop food wey don dey spoil or wey never cook well.

Wetin you suppose do if you get diarrhoea
Di most important tin na to get water to dey drink small small so bodi water go return to normal.
Make you try stay your house to rest
Make you avoid food or drink (like fruit juice) wey fit make di diarrhoea worse
Make you dey wash your hand wit soap and water after you go toilet and before you prepare or chop any food
Make you clean di toilet well well evri time you go poo-poo
Make you no share towel, cup and cutlery wit odas
Diarrhoea in babies and pikin dem (under 5 years)
Diarrhoea na one of di top disease wey dey kill plenti baby and pikin dem all ova di world especially for area where clean drinking water na problem. Di main problem wit diarrhoea be say di bodi dey loss too much water from watery poo-poo. If di child no get treatment and di diarrhoea continue, e go dey really weak and no go fit function wella.
If your pikin get diarrhoea, e dey very important to :
1. Give dem oral rehydration salts (ORS) – make you ask your pharmacist about dis
2. Continue to give your baby breast milk if you dey breast feed am (make sure say no be sometin wey you chop before or medicine you take, dey give your baby diarrhoea)
3. Make sure say you give small pikin wey dey take feeding bottle, water to dey sip between their feeding
4. Go see your doktor immediately if:
a. Di poo-poo get red or white colour
b. Di diarrhoea too much (like up to 10 times in one day)
c. Di pikin get plenti vomit on top di diarrhoea
d. Di pikin get fever on top di diarrhoea
e. Di pikin don dey lose weight
Comentários