top of page

COVID-19

Updated: Mar 14, 2024

COVID-19

Wetin be COVID-19?

Plenti virus wey dem they call coronavirus dey around tey tey. Many of dem no dey dangerous at all.

COVID-19 na disease wey one new kind of coronavirus wey first start for China for December 2019 bring come.

COVID-19 dey cause infection for inside nose, throat and lungs. E fit make am difficult for pesin to breathe normal.

Anybodi for any age fit get sick if dem catch di virus and e fit cause serious complicate or die sef.

Old pipo and pipo wey get oda serious health problem like heart problem, diabetes, asthma or cancer na dem dey get serious sickness pass. But dat one no mean say young pesin no fit sick too.



How COVID-19 dey spread?

Di disease dey spread when small small drop of water comot from di nose or mouth of of pesin wey get di virus. Wen di pesin sneeze, cough or even tok sef, anoda pesin wey tanda close to dem fit collect di virus wen dem dey breathe.

Di disease also fit spread wen pesin touch surface wey dis kain ‘virus’ water from sneeze or cough don land E possible make pesin get di virus fo bodi make im dey alright, but go dey pass am to oda pipo and dem go sick.


Wetin be di sign say you get COVID-19?


Di main sign wey pipo wey get COVID-19 dey show pass na:

  • Cough wey no dey gree stop

  • Fever: wen you chest or back dey veri hot when you touch am

  • Wen you no fit taste or smell anytin

Oda sign wey fit show na:

  • Bodi wey tire well well

  • Bodi ache

  • Headache

  • E dey hard to breathe

  • Sore throat

  • Cata

  • Vomit

  • Water poopoo

How you fit protect your self make you no get COVID-19?

  1. E get some simple tins wey all man fit do to protect our self and odas.

  2. Make you no tanda close to pipo so dat wen you cough, sneeze or tok, you saliva no go transfer to anoda pesin.

  3. Make you avoid places wey crowd full. E better to meet pipo for outside. If dat one no possible, you gats to leave plenti space from oda pipo.

  4. Make you leave window open so breeze go fit blow

  5. Make you dey wear mask wen you dey wit oda pipo. Di mask gats to cover you nose, mouth and chin. E no dey useful if e no cover your nose.

  6. Make you dey wash hand regularly wit soap and water or use hand sanitiser.

  7. Make you dey avoid to touch your face.

  8. Wen you wan sneeze or cough, make you no sneeze inside your hand. Make you sneeze or cough inside you elbow or inside tissue paper. Wash your hand wit soap and water afta you troway the tissue paper.


If you get COVID-19, how you go look afta yourself?

Plenti pipo wey catch COVID-19 no go get serious sickness and dem go fit recover for house. But e dey very important to know wen you need go see doctor.

If your temperature high:


  • Make you dey drink plenti water.

  • Make you rest well well.

  • Make you take paracetamol tablet (make e no pass 2 tablet four times a day) OR ibuprofen

  • If you dey cough, make you no lie down on your back. E better to lie down on your side or make you sit down for chair. Honey (one teaspoon three to four times evri day) fit also help make your cough better.

Make you call doctor or go di COVID-19 treatment centre wey dey close to wia you dey :

  • if you dey struggle to breathe when you stand or waka small

  • your bodi dey shake or you dey shiver

  • your bodi dey too ache

  • food no gree you chop


Oda kweshon wey pipo dey ask about COVID-19?

1. I know say I recently meet with pesin wey get COVID-19. If my bodi dey kampe, I still suppose stay for house?

If you sabi say you don recently dey in contact wit pesin wey get COVID-19, you no suppose comot for your house. Reason na bicos, anybodi fit get di COVID-19 virus for bodi make dem no sick, but dem go dey spread am to oda pipo wey fit get serious sickness or even die.

2. Small pikin fit get COVID-19?

Small children fit catch the virus like anybody. Children no dey usually get serious sickness, but dem fit dey spread the disease to oda pipo. If children get oda disease for bodi, e possible make dem get serious sickness wen dem get di COVID-19 virus

3. How COVID-19 dey affect woman wey carry belle?

Woman wey carry belle fit get the COVID-19 virus di same as oda pipo. If the belle don reach 7 months wen di woman get di virus, e dey more possible say di woman go get serious sickness. If you carry belle, e dey important to do all di tings wey go prevent the disease like to dey wear mask, to dey wash hand regularly and to avoid places wey crowd full.

4. How COVID-19 dey affect new born baby?

Newborn baby fit catch COVID-19 from anoda pesin wey get di virus for bodi, even if dat pesin no sick. To protect your baby from COVID-19, make you no dey allow oda pipo, enta your house during dis period wey di disease full ground.

5. Pesin fit get COVID-19 from mosquito bite?

According to World Health Organisation (WHO), even if mosquito bite pesin wey get di virus, come bite anoda pesin, dem no fit spread di virus.

6. Which medicine fit cure COVID-19?

Plenti scientist all over di world dey work hard to find wetin go cure di disease but till today, no medicine fit cure am. Di only ting wey fit prevent di disease na vaccine.

7. Vitamin C and D or Zinc fit cure COVID-19?

Vitamin C and D or Zinc normally dey help di bodi avoid infection but dem no fit prevent or cure COVID-19. If you take dem, e no mean say you no go catch di virus

8. Chloroquine or hydroxycloroquine fit treat Covid-19?

Plenti pipo sabi say chlroquine na malaria treatment. Plenti scientist around di world don check weda e go work well for COVID-19. The ansa dem find be say chloroquine or hydroxychloroquine no be cure for COVID-19. E fit even cause make pesin wunjure when e take am for COVID-19.

9. I fit wear mask when I dey do exercise?

When pesin dey do exercise come wear mask, e fit hard am to breathe well. So di advice be say make you no wear mask when you dey do exercise. Di important tin na to do di exercise for open area where oda pipo no too dey close to you.

10. Di thermometer gun wey dem dey use touch pipo head dey show weda pesin get COVID-19?

No, the thermometer gun na just to check pipo temperature. E no confam weda pesin get COVID-19. If pesin temperature high, na fever be dat. Plenti tings fit cause fever. COVID-19 na jus one of dem.


Comments


bottom of page