No get unecessary belle (Contraception)
- fouadkl
- Mar 2, 2024
- 5 min read
Updated: Jan 31
For woman wey don reach di age to get sex wit man, e dey important to know how to prevent unnecessary belle by using contraception.
Wetin be Contraception?
Contraception na di use of different method to stop make woman no carry belle.
Some of dis method dey use hormones (hormone na some kain chemical wey all man dey produce for bodi).
Oda method dey use some kain device or even operation for di contraception
Contraception dey allow husband and wife to decide wen dem ready born pikin.
E dey important to understand say many of dis contraception no dey protect pesin gainst Sexually Transmitted Infections (STIs). Condom (for man and woman) na di only contraception wey fit protect against STI and prevent belle at di same time. So if you dey use anoda kain contraception, you go need to dey use condom on top, to protect yourself against STI.
Which Kain Contraception Dey?
Condom
Condom na barrier method of contraception.
Dis one mean say e no dey allow sperm wey man release during sex to reach where di woman egg dey, so e no go fit fertilise di egg. Condom dey also protect pesin against STIs including HIV, syphilis and gonorrhoea.
E no dey allow infection to pass from one pesin to anoda. Male condom dey work well-well, and if pesin use am properly, e dey always prevent belle. But sometimes people no dey use am di way dem suppose and oda times e fit break.
Combined Contraceptive Pill
Most times dem just dey call dis one ‘Pill’.
Wetin dey inside na man made copy of some kain hormone wey dey inside woman bodi normally. Dem dey call dis hormones ‘Oestrogen’ and ‘Progesterone’ -woman dey produce am for dia ovary (dis na where woman egg dey form)
Woman wey don reach 35 years and get any of di following problem no suppose take dis pill:
If she don ever get blood clot
Serious liver problem
Heart problem
If she dey smoke
Make you always check with your doctor, which contraception method dey best for you.
Progesterone only Contraceptive Pill
Dis na progesterone-only pill,
Sometimes dem dey call am di ‘mini pill’.
E no contain any Oestrogen and e no dey as effective as di combined pill. Dis na because say pesin must take am for di exact same time every day. Na beta option for women wey dey get problem wen dem take oestrogen or pipo wey no fit take di combined pill because of health issue.
Dem dey normally use dis contraceptive after woman just born especially wen she still dey breast feed her baby.
Contraceptive Implant and Injection
Contraceptive implant and injection dey last for bodi tay-tay and dem dey work veri well. Dem dey usually give di injection evri 12 to 14 weeks and di implant dey last inside bodi for up to 3 years unless pesin wan remove am. Na only progesterone dey inside dem
Diaphragm
Diaphragm na barrier method of contraception
Dem dey put am for inside woman vagina, make e no allow sperm pass am enter di woman bodi.
Dis method no dey protect against STI.
Emergency contraception
Woman fit use dis method prevent belle if e get sex without protection or if any of di oda method no work. Na two types dey:
Morning after Pill
Dis one contain progesterone and di way e dey work be say e go delay egg wey di ovaries suppose release. Woman suppose take am within 24 hours after sex for say make e work, but e fit still work up to 5 days after (but dis one no get guarantee to work)
Intrauterine Devices (IUD)
Dis na small device wey get T-shape and na from plastic and copper dem make am.
E dey fit inside di womb.
E fit stay inside womb for up to 5 to 10 years.
Dem fit also use am as emergency contraception if demput am for bodi within 5 days after unprotected se (but na ogbonge medical expert go fit do dis procedure)
Some of dis IUD contain some kain hormone wey dey release small-small to prevent pregnancy.
Also, sometimes dem fit use dis IUD manage heavy menstruation.
Make you always check with your doctor, which contraception method dey best for you.
Vasectomy
Vasectomy na very simple and sure method of contraception for man.
Na small operation wey go block di tube wey dey carri sperm. E dey very quick and e no too dey pain. Normally, if dem do am, e dey permanent, so e dey veri important to discuss with your doctor weda you go still like get pikin before you decide to do di operation.
Female Sterilisation
Dis na anoda correct method of contraception wey dey permanently prevent woman to dey carry belle. Like Vasectomy, na very big decision wey woman go need discuss with her doctor well.
For di operation dem dey block di fallopian tube for di woman bodi wey dey carry di egg reach womb. Dis one no go allow di egg meet di sperm so di egg no go fertilise.
Na small operation and usually di woman fit go house that same day.
Vaginal Ring
Dis one na very small, soft plastic ring wey dem dey put inside vagina.
Dem dey remove am after twenty-one days. Seven days later dem go come put new one. Dis vaginal ring dey carry Oestrogen and Progesterone for inside, so e no good for women wey dey get problem with Oestrogen.
Make you always check with your doctor, which contraception method dey best for you.
Wen I Fit use Contraception after I Born Pikin?
E dey possible for woman to get belle again soon after she just born. Even if she still dey give baby breast or her period neva come back. So, e dey important for woman to plan di contraception wey she go use after she born. If woman born for hospital, she suppose follow her doctor or midwife talk before she go house.
Normally, woman wey no give pikin breast, go fit use any of di contraception
She go fit use di pill or vaginal ring 6 weeks after she just born or start to use di contraceptive injection as she just born finish.
Woman wey dey give pikin breast go fit use condom anytime, den after 4 weeks she go fit use contraceptive injection, di pill or vaginal ring after 6 weeks.
Make you always check with your doctor, which contraception method dey best for you.
If Woman Wan Stop Contraception?
As woman dey old, dey born pikin and even as her sex life dey change, she go need change di type of contraception wey she dey use.
From around 37 years, fertility for bodi dey reduce, but woman go still need use contraception around dis time make she prevent unplanned pregnancy. Around 55 years, most women go don reach menopause and di usual advice for dem na to stop contraception for dis age but dey must talk to their doctor first.
Comments