Breast Lump
- fouadkl
- Mar 3, 2024
- 2 min read
Updated: Mar 7, 2024
Wetin be Breast Lump?
Breast lump na growth wey woman dey see or feel for breast. Many of dis lumps no dey dangerous, but e dey veri important make woman see doctor make e check am immediately she notice am.
Signs wey woman suppose look out for
Normally, breast go sometime feel like say sometins dey inside and e fit feel soft as woman period dey come and go. If woman get lump for breast, di way her breast dey feel go change. She fit notice:
Lump wey dey round, smooth and strong.
Lump wey big and e fit move easily under di skin.
Di skin around di breast go dey red or e go be like say e get dimples.
Di size and shape of di breast go change.
Liquid go dey comot from di nipple.
If Woman See Lump For Breast, E Mean Say She Get Cancer?
Breast lump na one of di sign of breast cancer, but many times, no be cancer at all
Many oda condition fit cause am.
Incase woman observe lump for bodi, make she Follow Doctor talk sharp, sharp.
So, if na cancer, dem go fit start to dey treat am early - na den di treatment dey work pass.
Wetin Dey Happen When Woman Go Meet Doctor because of Breast Lump?
If woman go meet doctor for dis kain checkup, dem go do some tins like:
Ask her about her symptoms, medical history and her family medical history too.
Di doctor go use im fingers feel di breast area to check for di lump.
Mammogram/Ultrasound: Dem go use machine take proper picture of di breast so dem go fit check di details well
How Woman Fit Maintain Healthy Breast?
Woman need to pay attention to her bodi.
She need to know her bodi well.
If she dey feel one kain or observe any change, make she no waste time! She need to follow her doctor talk.
Breast Lump fit Show for Man Bodi?
Yes. Men fit develop condition wey dem dey call ‘Gynecomastia’.
E dey cause dia breast make e soft and e fit cause lump to form under dia nipple. Hormone wey no balance fit cause am or e fit come as side effect of medicine wey pesin take. Even though e no dey common at all, men fit get breast cancer too. So if man observe lump for im breast, he need to see doctor sharpally.
Comments