top of page

Breast Cancer : True True or Lie Lie ?

  • Jan 28
  • 2 min read

Updated: Feb 3

Na True True or Lie Lie



  • Women wey get big breast, na dem dey get breast cancer pass


Dis one na lie lie


Pesin get big breast no mean say e must get breast cancer

Plenti women wey get big breast, fit complain of back pain: but dis one no

mean say dem go get breast cancer

No mata di size of your breast, wetin dey important for woman dem na to dey

check your breast regularly, dey maintain healthy weight and regular exercise


  • Na only woman dey get breast cancer Dis one na lie lie


Many pipo bin tink say breast cancer na woman disease

But dis one no be true o Even though na woman dey get am pass, breast cancer dey affect man too So if man notice lump for him breast, he must to go see doctor sharp- sharp


  • Deodorant spray wen pesin dey use for armpit fit cause breast cancer

Sabi pipo (scientist) dem don check dis one, and up to now, dem neva see

say deodorant dey cause breast cancer


  • Pipo wey get breast cancer for dia family go usually get di condition

Dis one na True True

Pipo wey get breast cancer for dia family get higher chance of getting breast

cancer. But e dey important to know say breast cancer also dey common wit

women wey no get breast cancer for dia family

If you get mama, sister or daughter wey don get breast cancer (weda

dem dey alive or dem don die), you must go see doctor, so dem go start

to use machine examine your breast regularly. Dis na so dem go fit find

any cancer for your breast early and treat am sharpally


  • Women wey dey wear tight bra, na dem go get breast cancer pass

Some pipo bin dey tink say tight bra or di won wey get wire inside, no dey

allow di fluid inside breast to flow wella.

Dis one no be true tok

If your bra too small, e fit give you pain or hook di skin for your breast, but no

bi dis won go cause breast cancer

Comments


bottom of page