Breast Cancer
- fouadkl
- Jul 5, 2022
- 2 min read
Updated: Mar 18, 2024
Breast cancer na di most common cancer wey dey affect women. Most women wey get am go don pass 50 years in age but young women sef fit get breast cancer. E no dey too common, but breast cancer fit affect men too.
E dey possible to recover from breast cancer if doctor detect am and start to treat am on time. Das why e dey REALLY IMPORTANT make woman dey check their breast regularly to make sure say e no get lump or any oda kain changes.

Wetin be di sign wey fit show for breast cancer?
E get different sign wey fit show, but di one wey dey common na wen you notice lump for breast or di skin for breast get some kain thickness.
But pesin get lump for breast no mean say dem get cancer- infact most of di time e no be cancer at all, but e dey sensible to tell doctor about any lump wey you notice.
Oda sign wey fit show na:
If you notice say di shape or size of one breast or di two both breast change
If you get discharge wey mix wit some blood from your nipple
If you get lump or swelling for inside your armpit
If you get rash on top your nipple or for di skin around di nipple
If di appearance of di nipple change
If pesin get breast pain, usually e no be sign of breast cancer
Wetin dey cause breast cancer?
Dem never really sabi wetin dey really cause breast cancer, but e get some tings wey fit make am more likely for woman to get am:
as pesin dey old, e dey more likely to get breast cancer
if pesin for your family or your close relative don get am before
if you don get breast cancer before
if you don get lump (wey no be cancer) for breast before
if you tall, you dey overweight or too fat
If you dey drink plenti alcohol; di more you drink, di higher di chance say you go get am
Treatment dey for breast cancer?
If doctor detect di cancer on time, e dey possible for treatment to work well and even clear di cancer before e spread. Di treatment for breast cancer usually na combo of surgery, chemotherapy and radiotherapy
Usually na surgery be di first treatment pesin go get, den chemotherapy or radiotherapy go follow.
Surgery na to comot di cancer from bodi- di kain surgery go depend on di type of breast cancer wey pesin get.
Chemotherapy na treatment wey dey use pawaful drug to kill di cancer cell wey dey grow for bodi. E fit be one drug or many wey dem go use
Radiotherapy treatment dey use veri strong radiation (radiation na di kain energi wey x-rays dey use) to shrink and destroy cancer cell.
Comments