top of page

Bodi odour

Updated: Mar 7, 2024

Wetin be bodi odour?

Bodi odour dey happen wen pesin dey smell as im sweat mix wit bacteria wey dey on top skin. Sweat on e own no dey smell, but na wen e mix with bacteria, na den e dey release .

So if pesin dey sweat well-well e no mean say e go get bad smell or if e no too sweat at all, e no mean say bad odour no go dey.

Na di type of bacteria wey dey di skin dey determine if odour go dey or not.


Sweat na normal tin wey dey happen for bodi, but some food wey we dey eat or how clean pesin take be fit give sweat bad smell.

Sometimes if pesin dey develop certain sickness e fit also cause odour for di sweat.



Wetin Dey Cause Bodi Odour

Naturally, bacteria dey live on top our skin. Wen pesin sweat, di water, salt and fat wey dey inside di sweat go mix with di bacteria and e fit cause odour. Di odour fit be good or terrible odour or sometimes odour fit no even dey at all.

Tins like food, hormone wey dey inside bodi or medicine wey pesin dey take fit affect di odour.

Oda tins wey fit make bodi odour worse include:

  • Exercise

  • If di weather dey hot

  • Changes for di hormones inside bodi

  • If pesin dey fat

  • Sickness like Diabetes, Liver or kidney disease

  • Some kind drugs

Some Kain Food Wey Fit Cause Odour

  • Onion

  • Garlic

  • Cabbage

  • Red meat

  • Caffeine

  • Spices like curry

  • Alcohol

  • Spicy food

 

How Pesin Fit Treat Bodi Odour

  • Pesin need to dey baff everyday with antibacterial soap so skin go clean. Try focus on di area where sweat dey comot pass like di armpit and private part.

  • Dey shave di armpit so sweat go fit dey evaporate comot. Plenti bacteria dey grow for hair so if pesin comot di hair, chance of odour go reduce.

  • Dey wear clean cloth - ear cloth wey no too tight so skin go fit breathe.

  • Dey use anti perspirants (Roll-on) wey go help reduce sweat.

  • Avoid food wey fit cause odour.

  • Try reduce your stress level - too much stress dey increase sweat.

Wetin Pesin Fit Do If Armpit Dey Smell?

Some product dey wey fit deal with di smell wey dey comot for armpit.

Deodorant: Dis one dey cover bodi odour with pleasant smell.

Antiperspirant: Dis one dey reduce di amount of sweat pesin dey produce.

For smelly armpit e dey important say na anti-perspirant pesin dey use.

Pesin need to dey apply am afte baff and before sleep.

For make e work well, na on top dry skin pesin go rub am (na im be say wash and dry di bodi well well before you apply am)


Which Soap Dey Work for Bodi Odour

Na anti-bacterial soap wey fit wash away bad bacteria from di skin fit reduce bodi odour. Wen di odour strong well-well and e no gree comot after pesin don try dis kain soap, e go need to speak to Doctor, make e show am oda options wey e fit use.

Recent Posts

See All

Comments


bottom of page