top of page

Alcohol abuse

Updated: Nov 26, 2023




Wetin e be?

Alcohol abuse na wen pesin dey drink alcohol in a way wey fit damage e bodi. Pesin wey dey abuse alcohol no fit stay without drink for long time and wen e drink e dey always drink pass im limit.

If pesin too dey drink alcohol, e fit cause different kain health problem for am.


Wetin Overdrinking fit Cause?

Some common problem wey overdrinking fit cause na:

· Accident and injury wey go fit make pesin need to go hospital, like head injury.

· Too much alcohol fit dey make pesin cause wahala or enter unnecessary wahala.

· E fit go make pesin nack raw. Dis one fit lead to unwanted belle or even Sexually Transmitted Infection

· If pesin eye no clear because of alcohol, dem fit obtain pesin and e go come lose most of e belongings like phone, wallet and oda tins

· Drink fit poison di pesin and e go come dey vomit, dey shake, den e fit faint join.


If pesin continue to misuse alcohol, e fit cause more serious problem for bodi. Some of dem be:

· Heart disease

· Liver disease

· Stroke

· Liver cancer

· Bowel cancer

· Mouth cancer

· Breast cancer

· Brain damage wey go fit make pesin no dey remember tins or think well again.


On top all di health problem wey overdrink fit cause, e fit lead to family problem for some people. Pesin fit no get work or dem partner fit leave dem and for pipo wey don marry, e fit make husband and wife dey fight each oda all di time.

If pesin no fit do without alcohol, e go really affect e life, but di tin be say most pipo wey det di problem no go see am like dat. If pesin dey tell dem, dem no go wan believe am. If pesin wey dey overdrink alcohol everytime wan stop am, e no dey easy.

Many pipo wey try stop alcohol fit experience some kind sign for bodi, some of dem na:

· Dem hand go dey shake.

· Dem go dey sweat.

· Dem go dey see tins wey no dey dere.

· Dem go dey sad for no reason.

· Bodi go dey pepper am.

· Dem no go fit sleep.


How Pesin go Know if e get Overdrink problem?

· If bodi dey tell am say e need to reduce di way e dey drink.

· Oda pipo dey talk about how di pesin dey drink.

· If pesin mind dey judge am anytime e drink.

· If pesin need to drink as soon e wake up before e bodi fit calm down


How dem Fit Treat Overdrinking?

Some ways wey dem fit treat am na:

· Counselling- dis na wen pesin wey get drinking problem dey follow sabi pipo talk about di problem.

· Detoxification- dis one dey involve nurse or doctor. Dem go help pesin reduce di way e dey drink small-small with time. Dem fit still give am medicine wey go reduce di withdrawal sign.

· Medecine: Some kain medicine dey wey fit help pipo stop Follow doctor tok if you get problem wit alcohol


Alcohol and Belle

Woman wey get belle and woman wey dey try born no suppose drink alcohol.

If woman get belle and she dey drink, e fit harm di pikin. Di more alcohol wey di mama dey drink, di more di pikin for belle go wunjure. Sabi pipo recommend say if you get belle or if you get plan to born pikin, no drink at all!

If pesin get any question about alcohol during belle, make dem follow doctor or midwife tok.

If pesin dey try get belle, make dem partner no dey over drink alcohol, as e fit affect e sperm (make di sperm no strong)

Comments


Commenting on this post isn't available anymore. Contact the site owner for more info.
bottom of page